Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 22:57 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

57 But Pita sey, “Woman! Nor bi mi, I nor know am.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 22:57
12 Iomraidhean Croise  

But anybody wey deny mi for publik, misef go deny am for heaven.”


But Pita deny am for evribody front kon sey: “I nor know wetin yu dey tok about!”


But pesin wey rijet mi for where pipol dey, mi too go rijet am for where God angels dey.


One savant girl si Pita sidan near di fire, e look am for eye kon sey, “Dis man bin dey with Jesus too o-o.”


Afta sometaim, anoda pesin si am kon sey, “Yu dey with dem, nor bi so?” But Pita sey, “My friend! I nor dey with dem o-o.”


As Simon Pita stand for inside di kompond dey warm ensef, dem kon ask am, “Yu too nor bi one of en disciple?” Pita deny sey, “I nor dey among dem.”


Pita deny again for dia front and fawol kon do “Kukuruku.”


So make una turn from sin kom meet God, make E for forgive una,


But if wi konfess awa sin to am, e go forgive us kon wosh evritin wey nor good for God eye komot from awa life, bikos Christ dey always do wetin e sey e go do, since e dey raitious.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan