40 Wen dem rish der, Jesus kon tell dem, “Make una pray so dat una nor go fall enter temptashon.”
Jabez kon pray, “Israel God, make Yu bless mi and let my land big well-well. Make yor hand dey with mi kon save mi from trobol, so dat sofa nor go kill mi!” So God kon ansa en prayer.
Make yor words guide my step, so dat I nor go waka enter evil.
Na only yor ways I dey follow; I neva stop to follow Yu.
Make Yu nor let mi do anytin wey nor good for yor eye and nor let sin kontrol mi. Den I go dey innocent and I nor go sin again.
Nor allow us enter temptashon, but make yu save us from bad tins.’
Make yu forgive us awa sins, as wi dey forgive doz wey do us bad. Nor let us enter temptashon.’ ”
So Jesus tell dem, “Why una dey sleep? Make una get up pray, so dat una nor go fall enter temptashon!”
Di time wen evritin go end don near. So make una dey kontrol unasef and shine una eye wen una dey pray.
Bikos yu don obey my kommandment wey bi to get patient, I go protet yu wen I won test evribody for dis world.