38 Di disciples kon sey, “Oga God, si two swod for here.” Jesus ansa, “E don do.”
But one of di disciples wey dey with Jesus draw en swod kom out, kon kut di High Priest slave ear komot.
E kon tell dem, “But naw, pesin wey get money or traveling bag must karry am. And pesin wey nor get swod must sell en klot kon use di money by one.
Wen doz wey dey near Jesus si wetin won happen, dem ask am, “Oga God, make wi use awa swod?”
Jesus ansa, “My kingdom nor dey dis world. If to sey my kingdom dey dis world, my savants for fight make I nor kom meet di Jew oga dem. But as e bi so, my kingdom nor dey here.”
But since wi bilong to lite, make wi dey kwayet, use faith and love take protet awa chest, den wear di hope wey wi get like priest kap for head.
Make una nor gi-am shance, but make una faith strong, bikos una know sey na di same tin una brodas and sistas for evriwhere for dis world, dey sofa.