22 Bikos Man Pikin go die as God plan am, but curse dey for di pesin head wey go sell am!”
I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”
God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol
Man Pikin go die as dem rite about am, but curse dey di pesin head wey go sell am! E for betta sey dem nor born di pesin at-all.”
So Judas kon trow di silva koins inside di temple, den e komot go hang ensef.
Man Pikin go die as dem rite for God word about am, but curse dey di pesin head wey go sell am. E for betta sey dem nor born dat pesin at-all.”
So di disciples kon bigin ask each oda wish of dem go sell Jesus.
kon tell dem, “Na wetin dem rite bi dis, ‘Di Mezaya go sofa and e go wake-up from deat for di third day
Wen I dey with dem, I keep dem with yor name. No one lost, escept di one wey yor word sey e go perish.
E kon kommand us make wi prish and warn pipol sey, na en ensef bi di Pesin wey God choose make e judge pipol wey dey alive and di ones wey don die.
bikos E don choose one day wey E go take judge di world with raitiousness thru di man wey E choose and show evribody wen E raiz am from deat.”
na Judas sell dis man give Jew pipol, bikos na so God plan am from biginnin. Una know sey una kill-am, wen una gi-am to di sojas make dem nail am for cross.
Dem one know di time and di pesin wey God Spirit dey tok about. God don tok before about di sofa wey E sey Christ must sofa and di glory wey e go get.
and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.