26 Pipol go dey faint and fear go dey katch some, bikos of wetin dey happen for di world and difren pawas inside di sky, go shake komot for where dem dey.
Wen dat day rish, di sojas wey dey kom from far, go make loud nois give Israel pipol; di nois go sound like wave for sea wey nak rock. Den wen yu look di land, yu go si sey e skata and dey dark, bikos di kloud don turn dia lite to darkness.
“I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una.
“Difren-difren signs go show for sun, moon and star. For inside dis world, pipol for difren kountries go dey worry and fear, bikos of di way rivers go dey move and wota go dey rush from sea enter land.