Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 21:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Dat time, e go bad well-well for wimen wey get belle or get small pikin for hand! Strong wahala go kom for dis land and God ponishment go fall for pipol head.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 21:23
18 Iomraidhean Croise  

Wen dem distroy my pipol, even wimen wey love dia shidren, dey kook dem chop, bikos of honga.


So e sey, “I kom tell yu wetin go happen wen trobol go dey for di world. Dis vishon na about wen di world won end.


So di priest oga dem and di tishas kon ask Jesus, “Yu dey hear wetin dem dey tok?” Jesus ansa dem, “Yes! Una neva read sey, “ ‘Na shidren and small pikin wey dey suck breast go praiz God?’ ”


Dem ansa Jesus, “E go distroy doz evil pipol! Den e go hire di farm give oda farmers wey go gi-am wetin bi en own, wen harvest time rish.”


Di pesin wey fall for dis stone go skata and di pesin wey dis stone go fall on-top, go grind to powder.


For dis time, e go hard well-well for wimen wey get belle and doz wey get small pikin for hand.


For dat time, e go bad well-well for wimen wey get belle and doz with pikin wey still dey suck breast!


But doz my enemy wey nor wont make I bi dia king, make una go bring and kill dem for my front!’ ”


Time go kom wen una enemies go surround una for evry korna kon block una road.


Bikos true-true, di time dey kom wen pipol go sey, ‘E good well-well for wimen wey nor born or feed pikin at-all!’


Dis time wey wi dey nor eazy at-all and wetin I tink bi sey, e go good make una stay as una bi naw.


Dem even try to stop us, so dat wi nor go prish di message wey go give salvashon to Gentile pipol. As dem dey do so, dia sins dey plenty more-more. But naw, God vexnashon with ponishment dey kom meet dem.


Make una nor forget to do good and to share wetin una get with each oda, bikos doz kind sakrifice, dey make belle sweet God.


Yu wey get money, make yu listin! Cry make dem hear yor vois, bikos of di bad tins wey go happen to yu.


Di time for judgement don rish and e go start with God pipol. And if e start with us, wetin go happen to pipol wey nor dey obey God?


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan