But di sojas sey, “Make Jonatan wey win dis war for Israel, die? E nor go ever happen! As long as God dey alive, one hair for Jonatan head nor go even fall rish groun! Bikos na with God help, e take do wetin e do today.” So di sojas nor let dem kill Jonatan.