Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 21:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Una papa, mama, brodas, rilashons and friends go sey dem nor know una and dem go even kill some of una.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 21:16
14 Iomraidhean Croise  

Even yor own brodas and family dey against yu; dem don join doz wey won kill yu. Make yu nor trust dem, even doh dem dey trit yu well.”


Make evribody dey kareful of en friends and make yu nor trust yor broda, bikos even broda dey shit en broda. And friends dey lie against each oda well-well.


“Broda go sell en own broda give pipol make dem kill-am and na so papa go sell en own pikin too. Shidren go fight and kill dia papa and mama.


“Broda go betray en broda make dem kill-am and papa go sell en pikin. Shidren go betray dia papa and mama and dem go kill dem.


Papa go dey against en son and son go dey against en papa, mama go dey against en dota and dota go dey against en mama, husband mama go dey against en pikin wife and wife go dey against en husband mama.”


bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.


Evribody go hate una bikos of my name.


E kill James, wey bi John broda, with swod.


As dem dey stone Stefen, e kon pray, “Oga God, Jesus Christ, make yu receive my spirit.”


God pipol don win Satan with di Lamb blood and with di word wey dem tok about Christ. Dem nor too kare for dia life, so dem even dey ready to die.


I know sey yu dey stay for where Satan throne dey. But yu still whole my name strong well-well and yu nor deny mi even wen dem kill my savant Antipas for where Satan dey stay.


Wen di Lamb open di fift key, pipol wey dem don kill bikos of God word and wetin dem dey tok about Christ, I si dia soul for under di altar.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan