9 Jesus kon tell di pipol one parabol: “One man rent en grape farm give tenants, den e travel.
I bin plant una like special vine wey dem make with di best tins. So na how una kon take turn wiked vine, wey dey produce bad grape?
“One man wey dey travel kon koll all en savants divide en propaty give dem.
Jesus kon sey, “One big man travel go one far kountry where dem for won make am king and afta, e kom back.
Wen harvest time rish, e kon send one savant go meet di tenants make dem gi-am en share from di harvest. But di tenants beat di savant kon send am go back with empty hand.
Den Jesus tell dem, “Mi too nor go tell una who give mi di pawa to do all dis tins.”
For all di towns wey di Oga una God dey give una, make una pick doz wey fit judge from each tribe for Israel. Di judge dem must judge di pipol well.