6 But if wi sey, ‘Na from pipol’, dis pipol go stone us, bikos dem bilive sey, John na profet.”
Wetin una go si for outside? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet.
Herod kon get mind to kill John, but e dey fear di pipol, bikos dem bilive sey, John na profet.
But if wi sey, ‘Na from pipol,’ wi dey fear di pipol, bikos dem bilive sey na profet John bi.”
So dem kon dey try to arrest Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol bilive sey na profet e bi.”
But dem sey, “Make wi nor do am wen di Feast don start, so dat pipol nor go make trobol.”
Naw, dem won kon arrest am, but dem dey fear di pipol, bikos dem know sey Jesus tok dis parabol against dem. So dem kon waka leave am.
And yu, my pikin, pipol go koll yu God profet and na yu go-go prepare di road for di Oga God,
Dem kon dey tok with each oda sey, “If wi sey na from heaven, e go sey, ‘Den why una nor bilive am?’
So dem kon tell Jesus sey dem nor know where di baptizim from kom.
But di Farisee pipol and di law tishas rijet wetin God plan for dem, bikos John nor baptize dem.)
Many pipol kom meet Jesus for di place. Dem bigin dey sey, “Even doh John nor do any mirakle, but evritin wey e tok about Jesus, na true.”
So di soja oga wey dey di temple kon escort di savant go bring di apostles, but dem nor use force, bikos dem dey fear sey di pipol wey gada der, fit stone dem.