Where John baptizim from kom? Na from heaven or pipol?” Dem kon dey tok about di matter among demsef sey, “If wi sey, ‘Na from heaven,’ E go sey, ‘Den why una nor bilive am?’
Some among dem go meet John kon tell am, “Oga God, di pesin wey dey with yu for di oda side for Jordan River, wey yu tok about before, en too, dey baptize pipol and evribody dey rush go meet am.”
Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”
But as John dey finish en work, e kon tok many times sey, ‘Wetin una tink sey I bi? Nor bi mi bi di Mezaya. Make una si, somebody dey kom afta mi. I nor rish to remove shoe from en leg!’