Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 20:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 But Jesus look dem for face kon ask, “Wetin God word mean wen e sey: “ ‘Di stone wey di builders rijet, don turn to di main stone?’

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 20:17
17 Iomraidhean Croise  

bikos di stone wey di pipol wey dey build rijet, don turn to di main stone.


Naw, dis na wetin God tok, “I dey put one foundashon stone for Zion and dem rite dis word put, ‘Di pesin wey bilive and get faith, make e nor fear.’


Rulers, leaders and kommanders go kom from Judah and some go rule my pipol.


“Si, I dey put one stone wey get seven eye for Joshua front. I go rite put kon remove all di sin wey dis land don kommit.


Jesus kon tell dem, “Una neva read God word wey sey: “ ‘Di stone wey di builders rijet don bikom di pila? Dis na God work and e dey wonderful for awa eye.’


Den Jesus look round kon tell en disciples, “E go hard well-well for pipol wey get money well-well to enter God Kingdom!”


Una neva read God word wey sey, “ ‘Di stone wey di builders rijet, don turn to di main stone?


So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.


Wen Jesus near Jerusalem, e look di town kon dey kry,


Bikos I tell una, wetin dem rite for God word about mi must happen sey, ‘Dem kount am join criminals.’ Bikos wetin God rite about mi dey happen naw.”


Den Jesus turn look Pita for eye and Pita kon remember di word wey Jesus tell am, “Before fawol go do ‘Kukuruku!’ dis nite, yu go don tok three times sey yu nor know mi.”


Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”


All dis tins happen, so dat wetin God law tok, go bi true sey, ‘Dem nor get rizin to take hate mi.’


Dis Jesus Christ, di good stone wey una trowey, God don make am di main pila wey dey whole di house.


Dis na bikos, God don build una on-top di apostles and profets foundashon and na Jesus Christ bi di nomba one stone wey God take lay di foundashon.


God word sey, “Naw, I don lay one stone for Zion; di main stone wey I choose; no money fit buy am and anybody wey bilive am, nor go shame.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan