5 Josef and Mary wey e won marry wey get belle, go register togeda.
Dat time, Caesar Augustus kon give orda make evribody wey dey Rome go register dia name make dem for pay tax.
Evribody kon go en home-town go register.
So Josef wey dey stay for Nazaret for Galilee kon travel go Betlehem, David Town for Judea, bikos na David family e from kom.
As dem dey for Betlehem, time kon rish for marry to born.