40 Di pikin kon grow, dey strong, e get sense and God favor, dey with am.
Yet Yu allow my mama born mi well and I trust Yu from small pikin.
Na yu fine pass among evry oda man! Betta word dey kom out from yor mout and bikos of dis, God ensef don bless yu forever.
Di pikin kon dey grow and strong for spirit. E stay for wildaness until di day wen God show am to Israel pipol.
Evribody wey hear wetin Jesus dey tok kon dey sopraiz for di way e undastand and di ansa wey e dey give.
Jesus kon dey get sense more-more as e dey grow, so God and pipol like am well-well.
Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.
With God pawa, di apostles kon dey bear witness sey Jesus Christ wake-up from deat and God favor kon dey show for dia life well-well.
Finally, make una dey strong with Christ mighty pawa.
So yu, my pikin, make yu dey strong for di grace wey Christ dey give.
So wen di woman born, e kon koll di pikin, “Samson.” Di pikin grow well and God kon bless am.
Naw, Samuel dey serve for God house. Di boy wear klean linen klot.
So God really bless Hannah and e kon born three boys and two girls. Samuel grow for inside God house.
So, Samuel kon dey grow and get favor from both God and pipol.
Samuel kon dey grow and God dey with am. Anytin wey e tok, must happen.