38 For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem.
Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jew kansol memba, wey dey wait for God Kingdom and pipol dey respet am well-well, go meet Pilate kon ask for Jesus body.
One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.
One profetes dey, wey en name bi Anna, Fanuel dota, wey kom from Asher family. E don old well-well and e marry en husband for seven years, before di man die.