18 Evribody wey hear wetin dem tok, sopraiz well-well.
Si, mi and di sons wey God give mi, go bi signs and wonders for Israel pipol and na Oga God, di Pesin wey dey stay for Mount Zion, send us kom.
Wen dem si am, dem kon tok how di angel take tell dem about di pikin.
But Mary keep wetin e hear for en mind kon dey tink about am.
So di pikin papa and mama sopraiz for wetin Simeon tok about am.
Evribody wey hear wetin Jesus dey tok kon dey sopraiz for di way e undastand and di ansa wey e dey give.
Di pipol sopraiz kon dey ask each oda, “Wetin dey happen so? Dis man dey use God pawa take kommand demon and dem dey obey am!”