Tiberius Caesar don dey rule for fifteen years wen Pontius Pilate bi govnor for Judea and Herod dey rule Galilee, en broda Filip dey rule Iturea and Trakonitis aria and Lysanias dey rule Abilene.
One among dem wey en name bi Agabus, get up and di Holy Spirit kon put word for en mout sey, “Heavy honga go happen for di whole world.” Dis tin happen di time wen Klaudius dey rule.
I nor do bad and I nor kommit any offence wey dem fit take kill mi, I nor dey try to run sey make dem nor kill mi, but if evritin wey dem tok against mi nor bi true, nobody go fit karry mi, give dem. I sey make dem karry my kase go give Caesar!”
But Paul sey make dem take am go Rome, so dat Caesar go judge en kase, so I kon orda sey make dem keep am for prison, until I go fit send am go meet Caesar.”