5 Wen Jesus rish dat place, e look up kon sey, “Zakius, kom down kwik-kwik, bikos I must stay for yor house today.”
So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.
“ ‘ “Den wen I dey pass, I si yu dey roll for inside yor own blood for groun. Blood kover yor full body, but I nor fit look make yu dey die.
Man Pikin kom find and save pipol wey lost before.”
For der, e get one man wey en name bi Zakius. E get money well-well, bikos e bi tax kollectors oga. E don tey wey e
So e run go klimb one sikamore tree make e for fit si am, bikos Jesus go pass dat road.
So Zakius kom down kon welkom Jesus with happiness.
Netanel ask am, “How yu take know mi.” Jesus ansa, “Before Filip koll yu wen yu dey under di tree, I don si yu.”
Jesus ansa am, “Anybody wey love mi, go do wetin I tok and my Papa go love am, den wi go kon meet and stay with am.
Naw, bikos wi bi fellow workers, wi dey beg una make una nor waste God grace wey una don receive.
So dat Christ go dey inside una heart thru faith and wen una don strong well-well inside God love,
Make una always dey welkom strenja for una house, bikos like dis, some pipol don welkom angel enter dia house and dem nor know.
Listin! I stand for di door dey nok! If anybody hear my vois, kon open di door, I go enter go meet am, kon follow am chop and e go chop with mi too.