47 Jesus kon dey tish evriday for di temple. Di priest oga dem, di law tishas with di big leaders among di pipol kon dey find how dem go take kill Jesus.
Afta Jesus enter di temple, di priest oga dem and di eldas kon ask am wen e dey tish sey, “Na wish pawa yu take dey do all dis tins and who give yu di pawa?”
By dis time, Jesus tell di pipol wey follow Judas kom sey, “Una karry swod and stik kon arrest mi like sey I bi tif? I dey tish inside di temple evriday, but una nor arrest mi.”
Wen di priest oga dem and di law tishas hear wetin e tok, dem kon dey plan how dem go take kill Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol sopraiz for wetin e dey tish dem.
Two days before Passova and di Bread wey nor get yist Feast, di priest oga dem and di law tishas kon dey find as dem go take arrest Jesus, make dem for kill-am.
Jesus kon ansa am, “Na for publik I tok wetin I tish. Na inside sinagog and Temple where all di Jew pipol dey gada, na der I for dey tish. I nor tok anytin for sekret.