Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 19:41 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

41 Wen Jesus near Jerusalem, e look di town kon dey kry,

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 19:41
14 Iomraidhean Croise  

Elisha kon dey look Hazael one kind, sotey Hazael kon konfuse. Den di profet start to kry.


I dey kry like river wey dey flow, bikos pipol nor gri obey yor kommands.


Wen I si lie-lie pipol, e dey make mi sick, bikos dem nor kare about yor kommandment.


I dey vex for wiked pipol, bikos dem rijet wetin Yu tok.


So I kon sey, “Make nobody hold mi; make una allow mi kry well-well. Make I kry for my pipol, bikos dem don distroy dem and nobody dey to help dem.”


Den God go raiz-up as E do for Mount Perazim and for Gibeon Valley, so dat E go do wetin E won do. Even if wetin E dey do dey sopraiz us; E go komplete en wonderful work.


But as una nor gri listin, I dey kry for sekret, bikos of una pride; I go kry well-well till I nor fit kry again, bikos dem don karry God pipol go as slave.”


But my Oga, na Yu choose mi to serve yor pipol and dat na wetin I dey do. Yu know evritin wey I tok and I neva for wons ask Yu make Yu finish with dem.


I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.


Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.


den e sey, “I wish sey una know wetin go give una peace today! But naw, God don hide am from una.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan