22 “Di oga kon tell am, ‘Na yor word I go take judge yu, yu wiked savant! So yu know sey, I bi hash man; dey chop food wey nor bi my own and I dey plok fruit wey I nor plant?
den David tell di dead man, “Na yu use yor mout take kill yorsef: Yu kondemn yorsef wen yu sey yu kill di pesin wey God choose as king.”
Na di word wey yu dey tok, naim go fit free or kondemn yu for God present.”
So di king ask am, ‘My friend, how yu take enter here wen yu nor wear marriage klot?’ But di man nor fit ansa am.
Bikos I dey fear and know sey yu hash well-well. Yu dey chop food wey nor bi yor own and yu dey plok fruit wey yu nor plant!’
Den why yu nor put my money for bank, so dat wen I kom, I go kollect am with intrest wey go dey on-top?’
Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world.