19 “So di oga tell am, ‘Yu go bi oga for five towns.’
So make una tell innocent pipol sey e go betta for dem, bikos God go reward dem for wetin dem don do.
“Den di sekond one sey, ‘Oga God, I don gain five koins join di ones wey yu give mi.’
“Den anoda savant kon sey, ‘Oga God, si di money wey yu give mi. I keep am inside klot.
So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.
Di pesin wey plant di seed and di one wey wota am, na di same work dem dey do, but each pesin go get en pay from God akordin to en work.
Na wetin I dey tok bi dis; Pesin wey plant small, go harvest small, but di pesin wey plant plenty, go harvest plenty.
Make una shine una eye, so dat di work wey wi do among una, nor go lost, but instead, wi go get komplete reward.