8 I tell una true word, God go help dem kwik-kwik. But wen Man Pikin kom back, e go si pipol wey get faith?”
Bikos God dey stay di town, e nor go skata. Na from wen day just break, God dey protet am.
Some pipol dey tok how dem dey honbol and faithful, but e go hard to find pesin wey really bi like dat.
So, Israel pipol! Why una dey komplain sey God nor know una trobols or kare if una dey sofa at-all?
Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.
Jesus ansa am, “Rabbit and bird get dia own house, but Man Pikin nor get where e go fit rest en head.”
and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.