Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 18:43 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

43 At wons, di man bigin si and e kon follow Jesus, dey praiz God. Wen di pipol si wetin happen, dem kon bigin praiz God.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 18:43
30 Iomraidhean Croise  

So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem,


So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem.


God dey open blind pipol eyes kon karry doz wey dey weak, go up. God love pipol wey dey fear am.


My Oga God, I dey kry to Yu for help and Yu don make mi well.


Den blind eyes go open and doz wey nor dey hear, go hear word.


I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.


Na mi form dis pipol for mysef and dem go sing praiz mi!”


Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey cure leper, deaf pipol dey hear, pipol wey don die, dey wake-up and poor pipol dey hear di Good News.


Jesus heal pipol wey blind and doz wey nor fit waka inside di temple yard.


Wen di pipol si wetin happen, fear katch dem well-well and dem kon bigin praiz God wey give dis kind pawa to human being.


Wen Jesus tok dis tin, shame katch all en enemies, so di pipol kon dey happy, bikos of wetin Jesus dey do.


As e dey enter di road wey go Mount Olives, all di disciples kon dey happy, dey praiz God with loud vois for all di mirakles wey dem si.


So Jesus stand near di woman kon kommand di fever komot for en body. Kwik-kwik, di woman get up, bigin kare for Jesus and di odas wey dey di house.


Evribody for der sopraiz well-well. Fear katch dem and dem kon dey wonder dey sey, “Na wonderful tin awa eye si today so o-o!”


Den evribody wey dey der kon sopraiz as dem si God pawa. But as di pipol still dey sopraiz, Jesus kon tell en disciples,


Wen dem hear wetin Pita tok, dem nor argue with am again, so dem kon start to praiz God. Den dem sey, “Naim bi sey God don give Gentile pipol di shance to take turn from sin kom meet am, so dat dem go get di life wey nor dey end.”


yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’


Afta dem warn Pita and John well-well, di Jew pipol kon leave dem make dem dey go, as dem nor fit ponish dem for di pipol front, bikos dem gada dey praiz God for wetin happen so.


So dem kon dey praiz God bikos of mi.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan