42 Jesus kon tell am, “Make yu si naw, yor faith don heal yu.”
E send en words kon heal dem and E take dem komot from deat hand.
Bikos na afta E tok, di world start! As E kommand, di world kon appear at wons.
So Jesus tell am, “Madam, yor faith big well-well! Make wetin yu dey find rish yor hand.” Dat same time, di pikin kon well.
Jesus tosh di man kon sey, “Yes, I wont make yu well!” At wons, di sickness komot from di man body.
Wen Jesus turn round si di woman, e kon tell am, “My pikin, make yu nor worry! Yor faith don make yu well.” From dat time, di woman kon well.
Den Jesus tell di man, “Get up make yu dey go. Yor faith don make yu well.”
“Wetin yu wont make I do for yu?” Di man sey, “Oga God, I won si again.”
So, Jesus tell di woman, “Yor faith don save yu; make peace follow yu go.”
Jesus kon tell di woman, “My pikin, yor faith don heal yu. Make peace follow yu.”