Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 18:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Wen Jesus know sey di man dey vex, e kon tell di pipol wey dey with am, “E go hard well-well for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom!

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 18:24
18 Iomraidhean Croise  

Bikos dem dey make mout about di evil tins wey dem dey do. Yes! Dem dey praiz pipol wey get long-trot and dey curse God.


Doz wey trust dia propaty, go fall like wetin harmattan breeze blow; but raitious pipol go prosper well-well, dem go bi like sun wey dey shine.


Rish pipol dey tink sey di propaty wey dem get go protet dem like strong high wall wey dey round di town.


Bikos if I too get money, I fit deny Yu sey, ‘Who bi God?’ And if I too poor, I go fit go tif kon bring shame for yor holy name.


Pipol for dis generashon! Make una listin to wetin God dey tok: “Israel pipol, I bi like desert for una eye naw? Abi, I bi like land wey dark well-well? So wetin make my pipol dey sey, ‘Wi don free from God hand and wi nor nid am again!’


I go-go meet and tok to di leaders, bikos dem know wetin God wont and wetin E sey make dem do.” But even dem too don rijet God and nor gri obey en kommand.


Even doh e pain di king well-well, e nor won rijet wetin di girl ask, bikos e don promise for evribody present.


Wen di man hear dis one, e kon dey vex, bikos e rish well-well.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan