Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 18:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Wen di man hear dis one, e kon dey vex, bikos e rish well-well.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 18:23
15 Iomraidhean Croise  

So all di pipol gada kom listin to yu, but dem nor gri do wetin yu tell dem. Dem sey dem dey do di rite tin, but dem dey always dey shit and tif pipol money.


Wen di yong man hear wetin Jesus tok, e vex waka komot, bikos e get money well-well.


Wen di man hear dis word, e vex komot der, bikos e get plenty money.


Den Jesus tell dem, “Make una guide against long-trot, bikos nor bi wetin pesin get for dis life go save am.”


Wen Jesus hear wetin di man tok, e kon tell am, “E still get one tin wey yu neva do, make yu sell evritin wey yu get, give di money to poor pipol, den yu go get betta propaty for heaven. Afta dat, make yu kom follow mi.”


Wen Jesus know sey di man dey vex, e kon tell di pipol wey dey with am, “E go hard well-well for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom!


But Zakius stop kon tell Jesus, “Oga God si, I go give half of wetin I get to poor pipol and evribody wey I don shit before, I go pay am back four times!”


“So, make una shine una eye! Nor let party and wahala for dis life full una mind, if not, dat Day go kom wen una nor espect,


Di seeds wey fall for shuku-shuku, na di pipol wey hear God word, but wahala, plenty propaty and jolly-jolly for dis world kon shuk dem, so di fruit nor even ripe.


One tin wey una must know bi sey, pesin wey dey sleep with who e nor marry; wey nor dey pure or wey get long-trot and dey serve juju, nor go enter Christ and God kingdom.


Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,


So make una kill evry bad karata wey dis world dey bring: Like to dey sleep with pesin wey una nor marry; dey bihave anyhow; follow dis world tins; dey do bad tins; long-trot and to serve juju.


Make una nor love dis world or di tins wey dey inside am. If anybody love dis world, di Papa love nor dey inside am,


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan