Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 18:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 18:1
26 Iomraidhean Croise  

Pipol wey dey sofa, E go listin to dia prayers. E nor go rijet dem wen dem dey beg am.


But where I for dey naw, if to sey I nor bilive sey God go favor mi for dis land wey wi dey?


Bikos Yu hear and ansa awa prayers; so evribody go kom meet Yu.


Make Yu sorry for mi, my Oga God, bikos I dey always koll yor name.


But pipol wey dey wait for God to kom help dem go get new strent and pawa. Dem go fly high like eagle; even wen dem run, dem nor go taya and wen dem waka, dem nor go faint.


Make una nor let am rest till E build Jerusalem again kon turn am to town wey di whole world go dey praiz.


Den una go koll my name kon pray give mi and I go ansa una.


Wen I tink sey my life don dey finish, I kon pray give Yu and Yu hear mi from yor holy temple.


Bikos pesin wey ask, go get, pesin wey find, go si wetin e dey find and di pesin wey nok, di door go open for am.


But make una dey shine una eye evritime, dey pray make God give una pawa take pass all dis test wey go happen, so dat una go fit stand for Man Pikin front.”


Make una let una hope give una happiness. Make una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray.


So as wi get dis ministry, just as God don show us mesi, awa hope don strong well-well.


So make to do good, nor taya us, bikos wen time rish, wi go gain am.


With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.


Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.


Epafras, wey bi one among una and Christ savant, dey greet una. E dey pray well-well for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont.


Make una dey sirious for una prayer. Make una dey shine una eye as una dey tank God wen una dey pray.


Make una dey pray evritime.


As Hannah still dey pray give God, Eli kon dey look en mout.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan