Na Babilon pipol fine pass for all di kingdom and na dis make dem dey proud. But mi God, go distroy Babilon, just as I take distroy Sodom and Gomorrah!
Just as e bi wen I distroy Sodom and Gomorrah with di oda towns, na so too e go bi for Babilon. Nobody go ever stay der again. Mi, wey bi God, don tok.
Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.
“I distroy some of una town, just as I distroy Sodom and Gomorrah. And una wey remain bi like stik wey dey burn before dem komot am from fire. With all dis one, una still nor gri turn kom meet mi.” Na so Oga God tok.
Naw, God wey dey lead Heaven Sojas sey, “As long as I dey alive, I go distroy Moab and Ammon pipol finish, just as I distroy Sodom and Gomorrah. Na shuku-shuku go full dia land; I go turn am to salt pit and skata am forever. My pipol wey remain, go take evritin wey remain for di land.”
Make una use Sodom and Gomorrah and di towns wey dey near dem, as ezample. God ponish dem with fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey sleep with each oda anyhow, dem even dey sleep with animals and dem dey do oda wiked tins wey dey dia mind.
So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.