So Oga God distroy evritin wey get life for di eart: pipol, animals, di ones wey dey creep for groun and birds for di sky. All of dem die komot di eart. Only Noah and doz wey dey with am for di boat, naim save.
So, wahala go kom meet yu and yor majik nor go fit help yu. Wahala wey yu nor espect, go happen to yu at wons! Even trobol wey yu nor tink of, go rush kom meet yu like wota.
So di man take David go where Amalek pipol dey and David kon si sey dem full di land. Dem dey chop and drink; dey enjoy diasef, bikos of evritin wey dem karry from Filistia pipol and Judah land.