Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 17:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 One day, di Farisee pipol kon ask Jesus wen God Kingdom go kom. Jesus ansa, “God Kingdom nor go kom with sign wen pipol go si

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 17:20
9 Iomraidhean Croise  

For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.


Den e tell mi, “Dis na wetin Oga God dey tell Zerubabel: ‘Nor bi with force or human being bin pawa, but na with my Spirit.’


‘Even di san for una town wey dey awa leg, wi shake am komot make e bi witness against una. But make una know sey: God Kingdom don kom meet una.’


For one Sabat Day, wen Jesus go chop for one Farisee oga house, di pipol kon dey look am,


“Moses Law and di tins wey di profets rite, naim pipol dey follow, before John di Baptist kom. But since e kom, dem don dey prish di Good News about God Kingdom and evribody won force ensef enter.


As Jesus dey waka near Jerusalem, e kon tell di pipol one parabol to show sey God Kingdom nor go just kom like dat.


Jesus ansa, “My kingdom nor dey dis world. If to sey my kingdom dey dis world, my savants for fight make I nor kom meet di Jew oga dem. But as e bi so, my kingdom nor dey here.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan