8 “Di oga praiz di wayo manaja, bikos of di wayo sense wey e use. Bikos dis world pipol sabi use dia wayo sense for business pass pipol wey dey for lite.
Na snake play wayo pass any wiked animal wey God kreate. So di snake tell di woman, “Na true sey God sey, ‘Make una nor chop from all di tree wey dey di gardin’?”
So make una koll all di juju profets sey make dem kom meet mi, plus all dia savants and priests. All of dem must present, bikos I won offa betta sakrifice give di juju. Anybody among dem wey nor gri kom, I go kill-am.” But Jehu dey deceive dem, so dat e go fit kill all of dem wey dey serve juju.
My God, with di pawa wey dey yor hand, make Yu distroy pipol wey dey espect dia reward from dis world. But doz wey Yu like well-well, make Yu give dem enough and dia shidren go get plenty kon die leave propaty for dia shidren-shidren.
Make wi handle dem with sense, if not, dem go dey plenty more-more and if war happen naw, dem go join awa enemies fight us, den dem go run komot from dis land.”
Anybody wey tok bad against Man Pikin, God go forgi-am. But anybody wey tok bad against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, weda for dis life or di one wey dey kom.”
Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about.
Na like dis una go take know God and devil shidren. Pesin wey nor dey do wetin good for God eye and nor love en broda or sista for Christ, nor bi God pikin.