Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 16:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 (bikos I get five brodas), so dat e go warn dem, make dem nor for kom sofa for dis place.’

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 16:28
16 Iomraidhean Croise  

“So di rish man kon sey, ‘Abeg yu papa, make yu send Lazarus go my papa house for di world,


E kon kommand us make wi prish and warn pipol sey, na en ensef bi di Pesin wey God choose make e judge pipol wey dey alive and di ones wey don die.


Wen Silas and Timoti kom from Masidonia, Paul kon use all en mind dey prish di word, dey tok to Jew pipol sey, na Jesus bi di Christ.


As Pita dey tok to di pipol, e kon warn dem, “Make una save una head from di ponishment wey dey kom meet wiked pipol.”


I dey prish give Jew and Greek pipol sey make dem turn from sin kom meet and serve God and put dia faith for awa Oga God Jesus Christ.


escept sey di Holy Spirit dey warn mi sey, from town to town, na prison and sofa dey wait for mi.


But I nor kount my life to mean anytin, so dat I go fit finish my work and di ministry wey I receive from Jesus Christ, wey bi to prish about di Good News wey go make pipol undastand God grace.


For nite for di next day, Jesus kon stand near Paul tell am for vishon, “Make yu nor fear, bikos as yu don testify about mi for Jerusalem, na so yu go still do for Rome.”


But God don dey help mi till today, so I stand dey tell evribody, weda dem bi small pikin or big pesin. So, wetin di profets and Moses tok sey go happen, naim I dey tell una so,


Dem kon gri for di day wen dem go meet am and dem plenty wey kom en house kon meet am. So, from morning till evening, Paul kon dey esplain tins give dem. E dey tok about God kingdom and dey try to show dem wetin Moses Law and di profets tok about Jesus Christ.


Afta Pita and John don tell dia story and prish God word finish, dem kon go back to Jerusalem, dey prish God word for inside Samaria, as dem dey go.


And I dey warn evribody; anybody wey gri make dem sekonsaiz am, must obey evry oda tin wey di law tok.


So, I dey use Christ pawa take tell una dis tins sey, make una nor live una life like Gentile pipol wey dey tink only bad and tins wey nor get sense.


As unasef know, wi dey trit una as papa dey trit en shidren.


Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan