Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 16:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Nor bi only dat one sef, but dem block di centre, so dat pipol wey won cross from here go meet una, nor go fit and nobody go fit from una side cross kom meet us.’

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 16:26
15 Iomraidhean Croise  

Just as sheep dey waka like mumu, na so too dem go dey waka until dem enter dia grave; di place where Deat go bi dia shepad and oga. For morning, pipol wey dey fear God go rule ova dem. Dia body go rotin for grave wey nor even dey near dia fine house.


All of una wey don forget mi, make una turn from sin kom meet mi or I go kill una finish and nobody go kom help una.


God sey, “Di kountries wey surround and dey fight Israel pipol before, nor go fight dem again. Dat time dem go know sey na mi bi God wey get pawa.”


Den my pipol go si di difren between good and bad and between doz wey dey serve mi and doz wey nor dey serve mi.”


“So wiked pipol go enter ponishment wey nor go end, but raitious pipol go get life wey nor go end too.”


I tell una true word, yu nor go komot for der until yu pay all di money wey yu dey whole!”


“But Abraham ansa, ‘My pikin, remember sey wen yu dey alive, yu dey enjoy good tins, but Lazarus nor enjoy at-all. But naw, e dey enjoy for here and yu dey sofa for der.


“So di rish man kon sey, ‘Abeg yu papa, make yu send Lazarus go my papa house for di world,


Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”


Den, dem go trow di devil wey deceive pipol inside God fire. Den di beast and en fake profets go sofa both day and nite forever and ever.


Make di pesin wey dey do bad, kontinue to dey do bad and doz wey get dirty life must kontinue to live like dat. Di pesin wey dey do wetin good for God eye, make e kontinue to do am and di ones wey dey holy, must kontinue to dey holy.”


Wen Abigail go back go meet Nabal, e dey do party for en house like king. Nabal dey enjoy ensef and e don drink well-well. Abigail nor tok anytin until di next day.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan