Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 16:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 So e koll di manaja kon tell am, ‘I nor like wetin I dey hear about yu. Make yu go rite how yu take dey spend all my money, bikos yu nor go bi my manaja again.’

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 16:2
23 Iomraidhean Croise  

For evritin wey wi dey do, make wi know sey God go judge us; even di ones wey wi do for sekret, weda dem dey good or bad.


I tell una true word, for judgement day, pipol go ansa God for all di yeye word wey dem tok.


“Wen evening rish, di pesin wey get di farm kon tell en managa, ‘Koll di workers make yu pay dem, start from di last pipol wey I hire.


“But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’


Jesus ansa, “Who bi di manaja wey get sense and nor dey do wayo? Na pesin wey di oga put make e kare and give di oda savants dia food for di rite time?


Jesus tell en disciples, “E get one rish man wey hear sey en manaja dey waste en money.


“Den di manaja tell ensef, ‘Wetin I go do naw? My oga won sak mi and I nor strong rish to dig and na shame for mi to go beg.


So, all of us go tell God wetin wi do with awa life.


Bikos I don hear thru Khloe family sey, una dey kworel among unasef.


God wont make wi dey faithful to am.


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


Bikos all of us must stand for Christ front and e go judge us akordin to di tins wey wi do wen wi dey dis eart; weda dem good or bad.


Nor stop to dey use di spiritual gift wey yu get; bikos yu get am thru profesy, wen eldas put hand for yor head dey pray.


Remember sey some pipol dey sin make evribody si am and dis dey judge dem. But e get some wey yu nor go know dia sins naw, but leta, e go kom out for publik.


God don give evribody en own gift, so make una use di gift take help each oda as good savant wey get God grace.


For di day wen Christ go judge pipol wey dey alive and doz wey don die, e go ponish dem.


And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan