25 “By dat time, di senior son dey kom from farm where e go work. Wen e don near house, e kon dey hear music and si pipol dey dance.
David wey wear only linen for en waist, dance well-well to take honor God.
Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream!
Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,
Make wi dance praiz am with sheke-sheke; make wi praiz am with jita and flute!
Naw, Yu don turn my sorrow to happiness. Yu remove di klot wey I take dey mourn kon wear joy for my body like klot,
Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.
Time dey to kry and time dey to laf; time dey to mourn and time dey to dance.
I go build una again and una go take una sheke-sheke kon dance and dey happy again.
bikos dis my pikin die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, I don si am!’ So di party kon start.
So e koll one savant kon ask am, ‘Wetin dey happen?’
Dem bi like shidren wey sidan for market dey tell each oda, “ ‘Wi play music for una, but una nor gri dance; wi sing beri song for una, but una nor gri kry.’