23 Den, make una go take di melu wey fat pass, kill-am make wi do party,
Den e run go where di animals dey, take one melu wey fine and fat kon give one savant, wey kwik-kwik go kill-am.
Just as meat dey satisfy pesin na so too Yu satisfy my soul. So my mout go always dey praiz Yu
E betta to chop vegitabol with pipol wey yu love, dan to chop meat with pipol wey go fit kill yu.
E don kill animals to take do party, mix spice for inside di wine kon put am for di tabol.
For Mount Zion, God wey dey lead heaven sojas go do big party for all di pipol for di world. For di party, plenty food go dey to chop and wine go dey to drink; betta meat and sweet wine go dey too.
“But di papa koll en savants kon tell dem, ‘Make una bring di best klot, ring and shoe and make una wear dem for my pikin.
bikos dis my pikin die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, I don si am!’ So di party kon start.
Di woman kwik-kwik kill di small melu wey e get, take some flower, prepare am kon bake bread wey nor get yist.