So, Joab go meet David kon tell am wetin Absalom tok. Di king send message go koll Absalom kom and wen e kom, e bow for di king front, den di king welkom am with kiss.
So God ansa, “Israel, una bi my shidren wey I love well-well. I dey always tink of una with love wen ever I remember una name. Una dey for my heart and I go really sorry for una.
Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.