Una own don finish like who don die, bikos una pipol dey kommit sin. Una don spoil finish and dey do evil tins! Una sins dey bring una down, bikos una don rijet di Holy Pesin, wey bi Israel God kon turn against am.
But instead, una bigin laf and dey do party. Una sey, “Make dem kill sheep and melu make wi chop and make wi drink plenty wine! Make wi drink and chop, bikos wi go fit die tumoro.”
bikos my pipol don kommit two difren sin against mi: dem don leave mi wey bi di spring wey dey give dem fresh wota and dem dig one well for diasef wey nor fit keep and gada wota.
Pipol for dis generashon! Make una listin to wetin God dey tok: “Israel pipol, I bi like desert for una eye naw? Abi, I bi like land wey dark well-well? So wetin make my pipol dey sey, ‘Wi don free from God hand and wi nor nid am again!’
Dem go sofa for dis tins wey dem dey do, bikos dem feel sey dem fit do anytin wey dia body wont for day time and wen ever dem follow una chop, dem dey kause trobol among una.