31 “Abi wish king wey won go fight anoda king, nor go first sidan tink weda di 10,000 men wey e get go fit fight di 20,000 wey di oda king get?
Ahab ansa, “Make una tell King Ben-Hadad sey, ‘Betta soja nor dey make mout until e fight en war finish.’ ”
Make yu try go tosh am, den yu nor go ever try am again; bikos yu nor go ever forget di fight!
Make yu dey sure sey dem advise yu well, before yu make any plan or go start war.
Nor kwik karry matter go kourt, bikos if anoda witness show sey na yu dey wrong, den, na wetin yu go do?
Dem go sey, ‘Dis man start to build house and e nor fit finish am!’
If e si sey e nor go fit win, e go send messenja wen di oda king still dey far, go ask am how dem go take setol.