3 Jesus kon ask di pipol wey sabi di law well-well and di Farisee pipol sey, “E dey rite to heal for Sabat Day?”
One man wey en hand die dey der. Some pipol wey dey find as dem go take akuiz Jesus kon ask, “E dey rite to heal for Sabat Day?”
But wen di Farisee pipol si dem, dem kon tell Jesus, “Si, yor disciples dey break di law for Sabat Day.”
One of dem wey bi law tish kon ask Jesus one kweshon to take try am.
Jesus kon ask, “E good make wi do good or bad tin for Sabat Day? Make wi save or distroy pesin?” But dem nor ansa.
bikos one man wey en hand and leg swell-up, stand for en front.
Dem nor tok anytin. Naim Jesus hold di man, heal am kon sey make e dey go.
Den Jesus ask dem, “E dey rite to do good for Sabat Day” or “to save or distroy anybody life?”
Since una dey sekonsaiz for Sabat Day so dat una nor go break Moses Law, why una dey vex with mi, bikos I heal dis sick man for Sabat Day?