I don enter my gardin, my treasure and wife to bi! I don gada myrrh with spices and I don chop my honi-komb and my honey; I don drink my wine and my milk! Una wey sabi love, make una chop and drink until love shark una.
Israel pipol go bi like strong sojas and dem go happy like pipol wey drink wine. Dia shidren go remember as dem take win kon happy, bikos of wetin God don do.
Di Spirit and di Bride sey, “Kom!” Make di pesin wey hear sey, “Kom!” And anybody wey wota dey hongry, make e kom; di pesin wey wont di wota wey dey give life, make e drink from am free of sharge.