15 Wen one of di pipol for di party hear wetin Jesus tok, e kon tell Jesus, “God don bless evribody wey go chop for di party for en kingdom!”
“Wen dem go buy, di man wey won marry kon kom and di ones wey dey ready kon enter di party with am and dem kon lock di door.
Many pipol from east and west go kom follow Abraham, Isaak and Jakob chop inside God Kingdom.
Di savant wey en oga go kom back kon meet am dey work, make e happy well-well bikos di oga go prepare ensef make e for serve di savant food for tabol.
Pipol go from east, west, nort and sout kon sidan for di party for God Kingdom.
Bikos I tell una, I nor go chop am again, until evritin don komplete for God Kingdom.”
For my kingdom, una go sidan chop and drink for my tabol and una go sidan for difren thrones dey judge di twelf tribes for Israel.
Den di angel tell mi, “Rite dis tin wey I won tok naw: ‘God don bless pipol wey en invite kom chop for di Lamb marriage!’ ” E still tell mi sey, “Dis na God true word.”