14 Den, God go bless yu, bikos dem nor go fit pay yu back, but na God go pay yu wen E go raiz en pipol from deat; di pipol wey do wetin E like.”
Wen yu give sometin to poor pipol, e bi like sey God dey borrow from yu and God go pay yu evritin wey E borrow.
So dat una gift, go dey sekret and una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”
Instead wen yu dey do big party, make yu invite poor pipol, pipol wey dia leg or hand kut komot, pipol wey nor fit waka and pipol wey nor dey si.
and di angels go kon separate di pipol wey do good tins, so dat dem go enter life wey nor dey end, but God go kondemn di pipol wey dey do bad tins.
I get hope for God (di kind one wey dis men get too) sey one day, pipol wey don die, weda na bad or good pipol, go wake-up.