Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 13:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 But di oga for di sinagog vex sey Jesus heal pesin for Sabat Day, so e kon tell di pipol, “Wi get six days wen pipol suppose work, so make una kom make dem heal una for doz six days, but nor bi for Sabat Day.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 13:14
20 Iomraidhean Croise  

Una get six days to do all una work,


“Una go work for six days, but make una nor work for di sevent day, so dat una melu, donkey, slave and strenjas wey dey work for una, go rest.


I still give dem my Sabat wey go show my promise with dem, so dat dem go remember sey na mi make dem dey holy.


Yes! Una push di ones wey dey sick kon drive dem komot from where di oda sheep der.


“ ‘Una go work for six days, but di sevent day, na di day wey una suppose rest. For dat day, una nor go work, but una go gada woship God.


But wen di Farisee pipol si dem, dem kon tell Jesus, “Si, yor disciples dey break di law for Sabat Day.”


Den, one oga for di sinagog wey en name bi Jairus waka kom and wen e si Jesus, e fall for en front


But di Farisee pipol and di law tishas kon vex sotey dem nor dey si road again, so dem kon bigin ask diasef, “Wetin wi go do Jesus Christ.”


Di law tishas and di Farisee pipol dey look Jesus with korna eye weda e go heal pipol for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am.


Den Jairus wey bi oga for di sinagog waka kom. E fall for groun near Jesus leg, dey beg am make e kom en house,


Afta dem don read from di law and di profets book, di oga for di sinagog kon send message go meet dem sey, “Awa brodas, if una get any message to take enkourage di pipol, make una kon tok naw.”


Dem kon seize Sostenes, wey bi oga for di sinagog kon start to beat am for di judgement seat front. But Gallio do like sey all dis tins nor koncern am.


Krispus, di oga for di sinagog and en family, plus many Korint pipol wey hear about Jesus Christ, bilive and dem kon baptize dem.


I know sey dem love God, but dem nor undastand am,


Una fit work and do evritin wey una won do for six days,


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan