Si, Oga God! Why Yu dey ponish us like dis? Make wimen chop dia shidren wey dem love? Or make dem kill priests and profets for inside God temple, bikos of sofa?
kon sey, “Galilee pipol, na wetin make una stand der dey look heaven like dat? Dis Jesus Christ wey God don karry go heaven today, go still kom back di same way wey una si am dey go heaven.”
Afta am, Judas wey kom from Galilee kom out wen dem dey do census. E push pipol to join am oppoz wetin dem dey do. Dem still kill-am and all di pipol wey dey follow am skata too.