“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.
If anybody shame for mi and wetin I dey tish for dis world wey wiked and ashawo pipol dey, Man Pikin go shame for am too, wen e go kom back for en Papa and en holy angels glory.”
I know evritin wey yu dey do. (Si, I don open door for yu wey nobody go fit klose.) I know sey yu nor too get pawa, but yu don obey my word and yu nor deny mi at-all.