Di woman sey, “My king, abeg make yu pray give yor God, so dat my rilashons nor go kommit di crime wey big pass di first one kon go kill my oda pikin.” David ansa, “I use God name take promise sey nobody go tosh yor pikin.”
Make una look di birds wey dey fly for sky, dem nor dey plant or put anytin wey dem gada inside store, but una Papa for heaven dey feed dem. Una nor betta pass dem?
But di sojas sey, “Make Jonatan wey win dis war for Israel, die? E nor go ever happen! As long as God dey alive, one hair for Jonatan head nor go even fall rish groun! Bikos na with God help, e take do wetin e do today.” So di sojas nor let dem kill Jonatan.