Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 12:58 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

58 If yu and pesin get kase and una dey go kourt, make yu try setol with am for road, so dat e nor go drag yu go meet di judge, wey go give yu to sojas and dem go trow yu inside prison.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 12:58
20 Iomraidhean Croise  

Job! Abeg, go setol with God. Nor dey bihave like sey God na yor enemy. If yu follow am make peace, E go bless yu.


Since pesin wey dey rite with God fit go follow am tok, den E go diliver mi from pipol wey dey judge mi, forever.


So make evribody wey dey fear God pray to am as time still dey, so dat dem nor go sofa for judgement day.


All of una wey don forget mi, make una turn from sin kom meet mi or I go kill una finish and nobody go kom help una.


Make una turn and pray to God naw wen E dey near una.


“But e nor gri. Instead e karry am go put for prison, until e go pay wetin e whole.


Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon!


As spirit, e kon go prish give wiked pipol spirits wey dey prison,


I go try do evritin wey I fit do, so dat afta I don go, una go fit tok about dis tins.


My friends, even doh e don dey hongry mi since to rite give una about di salvashon wey wi dey share togeda, naw e strong well-well for my mind to rite, so dat una mind go dey strong. So una go fit stand fight for wetin wi bilive; di tins wey God don give en pipol and nor-tin go fit shange am.


Wen di 1,000 years don finish, God go free Satan from en prison


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan