Oga God sey, “True-true, Judgement day dey kom; e go kom like strong fire. All doz sturbon and wiked pipol go fall and dat day dem go burn die. Both dia rut and branches go burn finish.
But di savant wey nor know wetin en oga wont and e do tins wey go make dem flog am, dem go flog am small. Pesin wey God give plenty tins to, E go ask plenty tins from am and di ones wey God give plenty, E go ask doubol from dem.”